Poem: Traitor

Photo by Matheus Ferrero on Unsplash

Why you dey hurt me so?

Why you dey take joy with my tears?

Una wetin I come do you?

No be d same God dey create me whey dey create you too?

No be human being we dey so?

So why hurt me like dis?

We used to be close,

We used to be friends,

Yet you stab me for back,

You troway me for gutter,

You dey laugh,

You dey shame,

You dey mock me for my weakness

As if say you dey holy holy,

You pretend to be nice in public,

Yet when no one dey you dey behave like demon,

Chai!! Baba God una wetin I do oh?

Which sin I commit to find this devil of a friend?

Whichever way, I no longer send you,

So thunder fire dat your reason and your black heart!

--

--

Damilola Abiola-Tikare

Hi there.I am Damilola Abiola-Tikare and I am a Content Writer who is also a Digital Marketing Diva. Watch this space for more marketing content.